Ghana vs Mali highlights: Jordan Ayew late goal restore Blackstars 2026 FIFA World Cup dream - BBC News Pidgin (2024)

Ghana vs Mali highlights: Jordan Ayew late goal restore Blackstars 2026 FIFA World Cup dream - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Article information
  • Author, Komla Adom
  • Role, Senior Reporter
  • Reporting from Ghana

Jordan Ayew late goal for extra time don win all three points for Ghana against Mali for dia crunch 2026 World Cup Qualifier for Bamako.

Di Blackstars for long time for di game dey under pressure wit di Mali players creating chance afta chance.

Kamoury Doumbia score on di stroke of halftime afta im shot hit Alexander Djiku wey e come hit am again to enta di net.

Afta di first half, Ghana don try to grab di equaliser. Ernest Nuamah wey dey play for Lyon head di ball into di net afta one cross from Salis Samed.

Both teams make changes wey dem create plenty chances, but ibi Crystal Palace striker Jordan Ayew wey pounce on one loose ball to score for extra time to win di game 1-2.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Wit dis result, Ghana don move to second for di table wit 6 points afta Comoros wey also get 6 points.

Mali now dey third wit 4 points, di same as Central African Republic while Madagascar dey fifth wit 3 points.

Chad remain bottom of di group wit zero points.

Ghana go face Central Africa Republic for di Baba Yara sports stadium on Monday

Mali vs Ghana highlights

Ghana vs Mali highlights: Jordan Ayew late goal restore Blackstars 2026 FIFA World Cup dream - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Second Half

Referee don blow whistle for di end of di game. Ghana win 1-2 against Mali

95" Mali don shock at wetin happun. Afta di restart dem try to score but di ball go over.

94" GOOOOOOAAAAALLLL! Ghana don score. Substitute jordan Ayew pounce on a lose ball inside di box to score

1-2

93" CHAAAANCE! Captain Thomas Partey enta di box one-on-one, wey im wan chip di goalkeeper. but di keeper save am.

92" Mali try to create something but di final ball dey loose. Ati-Zigi claim am. Time dey finish

90" Ghana get counter. Jordan Ayew begin di attack, im pass to Tarique Lamptey, but Ghana no fit to take advantage wey di chance vanish.

89" Dem don add 5 additional minutes for dis game. Anybodi fit to grab di winner.

87" Mohammed Kudus don comot wey Leicester City forward Issahaku Fataw don enta. Ibrahim Sulemana also enta for im debut to replace Salis Samed

86" Tarique Lamptey drive di ball into di Mali area wey im pass to Kudus. Di Westham man try to cutback but no blackstars player fit connect.

84" Ghana substitute Elisha Owusu don chop di first yellow card of di game for a foul inside di midfield as Mali dey try to create chance.

83" Jordan Ayew dey try to use strength to beat two, three Mali defenders, but im no fit wey im concede throw in.

82" Mali make anoda sub wit Sekou Koita. Im come replace Adam Traore

81" Ghana dey try to create something wit Jordan Ayew for di flank, im try to cross di ball but im fo settle for corner.

80" Ten minutes to go. Any of di two teams fit get di winning goal? Na time go tell.

77" Ghana don dey make more changes. Jordan Ayew don replace Antoine sem*nyo wey Abdul Mumin come on for im blackstars debut. Im replace Alidu Seidu.

76" Referee don blow whistle for anoda cooling break!

76" Adama Traore get one chance on goal but im drag di shot wide afta ghana lose possession for midfield.

75" Mali get corner. But ghana clear am. Mali begin to regroup to attack again.

73" Antopine sem*nyo dey through on goal, but im delay im shot wey di Mali defender come block am. Di Bournemouth striker tok say na corner, but ref say goalkick.

73" Di fans for di stadium don begin dey scream afta every Mali chance, but di blackstars dey manage to create some of dia own chance.

71" Ghana don make one change. Di goalscorer Ernest Nuamah comot wey Elisha Owusu wey dey play club football for Auxerre don come inside.

71" CHAAANCE! Mali strijer Bilal Toure get correct header but e go wide. Di player don frustrate about dat missed chance.

69" One Mali sub Nene wan enta di Ghana box but dem block am wey im dive for penalty. Di ref wave play on.

67" Mali begin to create dangerous chance. Dia forward don dey dance inside di Ghana box wey im cut di ball to im colleague, but di striker wit di number 9 jersey don shoot wide.

66" Mali don make four substitutions. Di coach Eric Chelle wan re-establish di lead for here but so far di subs no make any real impact.

64" Mali get corner. But Ghana clear

63" Poor corner. Di Mali defense don clear am.

62" Tarique Lamptey don cross di ball into di Mali box, but dem clear am. Afta di subsequent attack, Ghana don win a corner.

61" Both teams wan dominate afta dat Ghana goal.

57" GOOOOOAAAAALLLL! Ghana don equalize wit Ernest Nuamah header from

one Salis cross.

1-1

56" Kudus get chance to shoot inside di box, but dem block di shot.

54" Mali dey prepare to make three changes.

52" Mohammed Salisu dey sit for ground. Di medical team dey attend to am. Dis na afta Mali try to play one ball ova di top to di striker.

49" Mali get corner from dia first attack for dis second half but Traore connect wit di ball but e neva dey trouble Ati-Zigi.

48" Di blackstars begin to pile some pressure for di Mali area, but e neva dey trouble dem.

45" Early chance for Ghana. sem*nyo stretch to connect wit one inviting ball inside di area, but im no fit. Ghana win di corner but di resulting kick don go wide from a Djiku header.

45" Second half don begin wit no changes for both teams.

First Half

Halftime!

47" Ghana try from di restart to create a chance wey dem get corner but di blackstars waste di corner. Referee don blow whistle for halftime

45" GOOOOAAAAALLLL! On di stroke of halftime, Mali don score. Lassine Sinayoko cut di ball back into im colleague Kamoury Doumbia wey dey wear number 10 shirt.

Doumbia hit di ball wey e hit a blackstars defender Djiku wey e don hit Doumbia again wey e enta di net.

1-0

44" Di game don slow down small. Dem add two mins to di first half

42" CHANCE! Thomas Partey pick up di ball inside di midfield wey im pass for sem*nyo. Di strike take one touch, wey im try to bend di ball wit im right foot but di ball go wide!

41" Mali create chance in front of di Ghana box, but di defenders don block di shot. Kudus wan begin di attack but im slow tins down wey e pass di ball back to im teammate.

40" Gideon Mensah play di ball to Ernest Nuamah say make im run chase am, but di Lyon forward no fit to keep di ball on top di park.

39" Ghana don begin dey create some decent chances.

38" Partey play one fine pass into sem*nyo - di Bournemouth striker beat im marker but im cross-cum low shot no find any player wey im go throw.

36" Ghana enta di mali box wit Tarique Lamptey wey im cross a low ball but Kudus no get space to shoot.

Di Mali keeper don collect di backpass from im player, but referee say play on.

35" One Ghana player don fall for ground. Ernest Nuamah don dey hold im stomach. Ibi like im go dey fine to continue.

33" Ghana survive di pressure from dat Mali attack.

32" Right from di restart Mali begin to creat chance wey dem win corner from a Salisu clearance.

32" Ref don restart di game!

29" Cooling break! Both sets of players gatz to drink some water as di weather dey sama dem well well.

28" Ghana don begin to string three, four passes togeda, wit a cross inside di area for Gideon Mensah; but im cutback neva find im colleague. Di chance don disappear.

26" Anoda wild shot from distance by di Westham poster boy, Kudus. Di ball don rise go off target.

Still 0-0

25" OFFSIDE! sem*nyo try to chase one high ball ova di top into di Mali area but di linesman don raise flag for offside.

24" Kudus try one shot from range but di weak effort go wide off di Mali keeper im left side.

22" But di freekick don clear bodies inisde di box wey im go out. Gideon Mensah clear di ball

22" Mali win freekick from tight angle around di right hand side of di blackstars box

21" Di eagles of Mali don dey pass di ball around well well in front of di black stars area

20" Ghana dey struggle to clear dia lines, dem also dey struggle to put passes togeda.

17" Anoda Ghana freekick enta di box, but e dey too high for sem*nyo.

16" Thomas Partey take di freekick short to im teammate, na so di chance miss. Ghana get throw ball but sem*nyo im touch carry di ball go anoda throw for Mali

15" Ernest Nuamah win freeck inside di center circle for di blackstars - im dey okay to continue.

13" Ghana don concede freekick inside di Mali half - afta di restart, Traore don put Salisu under pressure inside im own box, but referee blow whistle for foul against di Mali forward.

12" Mali begin to dominate di game until one lose ball don reach Ernest Nuamah from Ghana. But di attack don break down.

11" Alidu Seidu from Ghana don concede anoda corner. Mali don dey pile pressure for di Ghanaians.

10" From di corner, Mali hit one shot on target, but di keeper make di save.

9" Mali fly one ball into di Ghana area but di ghana defender clear am for Mali dia first corner

8" Mali don dey create some sustained possession inside midfield. Kudus try to break di play but im lose di ball to di Mali midfield.

7" Ghana begin to string some passes togeda, wit Partey from midfield. Tariq Lamptey carry di ball run enta di Mali area but im cross go wide.

6" Anoda Mali attack from di freekick see di ball enter di blackstars area, but At-Zigi comot come collect

5" Kudus commit foul inside di Mali area, referee blow whistle wey Mali don begin di play from di back

4" Mali don dey pile early pressure wit a stinging shot from striker Lassine Sinayoko, but goalkeeper Ati-Zigi make quick save

Both teams don dey struggle to take control of di game for di early stages

3" Blackstars win throw in for di opponent half but dem waste am

2" Early chance for Mali but di long ball no find di attacker, Ati-Zigi pick up di ball

1" Mali don win early freekick; goalkeeper Mamadou Samassa don kick am inside

1" Ghana begin kickoff and seconds afta Mali win throw

Match don start

Di two teams don comot for field for dis crucial match between Blackstars of Ghana and Eagles of Mali.

Starting XI for Ghana

Ati - Zigi (GK); Alidu Seidu, Traiq Lamptey, Alexander Djiku, Mohammed Salisu, Gideon Mensah, Ernest Nuamah, Thomas Partey (C), Mohammed Kudus, Abdul Samed Salis, Antoine sem*nyo

Starting XI for Mali

Mamadou Samassa (GK); Daouda Guindo, Sikou Nakate, Modibo Sagnan, Falaye Sacko (C), Mohammed Camara, Amadou Haidara, Kassana Coulibaly, Kamory Doumbia, Adama Traore, Lassine Sinayoko

Ghana vs Mali highlights: Jordan Ayew late goal restore Blackstars 2026 FIFA World Cup dream - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Aron Pacocha

Last Updated:

Views: 5521

Rating: 4.8 / 5 (68 voted)

Reviews: 83% of readers found this page helpful

Author information

Name: Aron Pacocha

Birthday: 1999-08-12

Address: 3808 Moen Corner, Gorczanyport, FL 67364-2074

Phone: +393457723392

Job: Retail Consultant

Hobby: Jewelry making, Cooking, Gaming, Reading, Juggling, Cabaret, Origami

Introduction: My name is Aron Pacocha, I am a happy, tasty, innocent, proud, talented, courageous, magnificent person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.